Sports

Super Eagles Fans Believe Say Nigeria Go Beat Madagascar

todaySeptember 24, 2026 9

Background
share close

As 2027 AFCON qualifier dey come, some Super Eagles fans don show confidence say Nigeria go beat Madagascar.

Nigeria and Madagascar go play dia opening 2027 AFCON qualifier on Friday, September 25, for Godswill Akpabio International Stadium, Uyo, Akwa Ibom.

According to reports, both teams train separately for Uyo on Tuesday as dem continue preparations for di match.

And fans tell tori pipo for Lagos on Wednesday say Naija get enough quality players wey fit secure victory, while football scout Emmanuel Alozie also back Super Eagles to collect di three points.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds