US

14 Results / Page 2 of 2

Background

obodo oyinbo

US- Israel Continue attack in Iran, kpaiing Many Pipo

Say US and Israel don increase attack for Iran, dem target old medical research centre for Tehran, one bridge near di capital, plus steel plants. Dis one sef dey come after U.S Presido, Donald Trump promise Iran say im go take Iran  back “Stone Ages.” For Iran military, say di war go continue until dia enemies shame and surrender.

todayApril 3, 2026 31

obodo oyinbo

Iran Yarn Say Dem Go Hit US Hard After Trump Threaten Dem

On Thursday, Iran yarn say dem go give US and Israel crashing attacks, as dem fire missile reach Tel Aviv after US President Donald Trump talk say dem go bomb Iran “back to Stone Ages.” Di fight don dey since US and Israel start strike Iran over one month ago, e don spread for whole Middle East, dey shake global economy, affect plenty millions pipo worldwide. For White House talk, […]

todayApril 2, 2026 24

obodo oyinbo

US Plan Ground Attack On Iran Even As Talks Still Dey Go On — Iranian Speaker Yarn

Iran parliament speaker, Mohammad Bagher Ghalibaf, don blast say US dey plan ground attack coded, even as dem dey form say dem wan do peace talk. E talk say enemy dey shout negotiation for outside, but lowkey dem dey arrange ground attack. E still yarn our soldiers dey wait make US troops show face, make dem roast dem and deal with dia  allies finish. Dis gbege start since Feb 28 […]

todayMarch 29, 2026 20

obodo oyinbo

Make Una Stop Di War – Guterres Yarn

UN Secretary-General António Guterres don sama warning  say di war wey United States and Israel dey fight Iran don dey out of hand. Im yarn dis on Wednesday for New York, say e dey urge all sides make dem step back and try settle di mata wit diplomacy. Guterres explain say di conflict don spread pass wetin leaders bin expect, and e fit cause plenty suffering and economy wahala. E […]

todayMarch 26, 2026 30

obodo oyinbo

US Send 15-Point Peace Plan To Iran

Iran don receive 15-point peace plan from US, and dat na Pakistan deliver am as intermediary dis week to try settle di nuclear issue. Di plan, wey dem no show to  public, fit help stop some of Iran nuclear facility and US suppose also remove sanctions from Iran. One Israeli minister explain di mat give tori pipo on Tuesday say di plan fine for paper, but e be like say […]

todayMarch 25, 2026 29

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds