WHO

5 Results / Page 1 of 1

Background

obodo oyinbo

WHO Clear Cruise Ship From Deadly Disease, Hantavirus

Di World Health Organization (WHO) on Thursday declare say di deadly hantavirus outbreak inside di cruise ship MV Hondius don officially end after di last person leave quarantine. Inside press conference, WHO Oga Tedros Adhanom Ghebreyesus naim announce di ogbonge update. U sabi say, na 12 pipo catch di virus and three kpai since di ship comot Argentina on April 1. And dis mata bin shake everywia for dat April […]

todayJuly 3, 2026 9

obodo oyinbo

WHO Release New Treatment Guideline

World Health Organization don release im first complete clinical guidelines for filovirus diseases as Democratic Republic of di Congo dey battle new Ebola outbreak wey come from Bundibugyo virus. WHO talk say di new guideline cover both Ebola and Marburg virus diseases for one document and e give 16 evidence-based recommendations to improve treatment and patient survival. Dem stress say early supportive care and standard treatment methods get serious role […]

todayJune 18, 2026 9

obodo oyinbo

Ebola Spread Enter New Areas For DR Congo

World Health Organization (WHO) on Friday don share update say Ebola don dey spread enter northeastern Democratic Republic of Congo, especially for Ituri, North Kivu and South Kivu. WHO epidemiology head, Olivier le Polain, naim dey give dis update, say di virus dey enter new health zones almost every day, showing how di outbreak big and hard to control. According to WHO, since dem declare di outbreak on May 15, […]

todayJune 12, 2026 12

obodo oyinbo

WHO Give Uganda Big Respect

Di head of di World Health Organization, Tedros Adhanom Ghebreyesus, don hail Uganda as dem dey try well-well to stop di Ebola virus from spreading enter inside dia country. Oga Tedros, wey visit Mulago National Referral Hospital for Kampala on Monday, talk say Uganda really dey handle di matter sharply. Dis praise dey come after WHO declare di Ebola outbreak a heavy international emergency, as di sickness don kpai 91 […]

todayJune 9, 2026 7

obodo oyinbo

By : Jolayemi Olajide World Health Organization officials on Tuesday don warn say Ebola outbreak for north-eastern DR Congo dey spread faster than dem first think. Dr Anne Ancia of WHO tell newsmen say as dem dey investigate more, dem dey discover fresh cases for different areas around Ituri province, wey be di centre of di outbreak. Residents for di area talk say na so pipo dey die, die anyhow, […]

todayMay 19, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds