Di World Health Organization (WHO) on Thursday declare say di deadly hantavirus outbreak inside di cruise ship MV Hondius don officially end after di last person leave quarantine.
Inside press conference, WHO Oga Tedros Adhanom Ghebreyesus naim announce di ogbonge update.
U sabi say, na 12 pipo catch di virus and three kpai since di ship comot Argentina on April 1.
And dis mata bin shake everywia for dat April but, di number one bodi mata pipo don konfam dat di hantavirus don finally mihaoon go back wia e come from.