world cup

21 Results / Page 2 of 3

Background

Sports

Rice And Odegaard Go Face Each Other For World Cup Quarter Finals

By Oluwatosin Ibrahim Declan Rice of England and Martin Odegaard of Norway go meet each other for di FIFA World Cup quarter-final. Di two players be teammates for Arsenal Football Club in London, where dem help di club win di Premier League title and reach di UEFA Champions League final. But now, dem go stand against each other because Rice dey represent England, while Odegaard dey captain Norway. Both players […]

todayJuly 10, 2026 22

Sports

Zeki Amdouni Fit Retire From Professional Football Dis Week

Switzerland star, Zeki Amdouni, don yarn say he fit retire from professional football once he face Lionel Messi for FIFA World Cup. He yarn dis one for him Snapchat on Tuesday after Switzerland beat Columbia. Amdouni joke say after di match, he go just end im football career. Argentina wey be defending champions go jam Switzerland for quarter-final later this week.  

todayJuly 8, 2026 39

Sports

Pape Gueye Retire From International Football

Senegal midfielder, Pape Gueye, don announce say e no go play for Senegal national team again as long as head coach, Pape Thiaw, still dey in charge. Di 27-year-old make di announcement for social media after Senegal blow two-goal lead come lose 3-2 to Belgium after extra time for dia 2026 FIFA World Cup Round of 16 match. For di post wey e write for French, Gueye tok say e […]

todayJuly 2, 2026 41

Sport Yarns

England  set eye for dia long-awaited glory as World Cups

By : Jolayemi Olajide Unto di world cup update, England don dey fire body to begin dia mission to end 60 years trophy without winning any trophy. Today dem go face Croatia for dia World Cup opener. Meanwhile, Cristiano Ronaldo, wey be 41 years, go feature for record-equalling sixth World Cup as e dey prepare to lead Portugal against DR Congo for Houston.  

todayJune 17, 2026 23

Sports

Reno Omokri Reply Davido

Ambassador to Mexico, Reno Omokri, don fire back at Afrobeats star, Davido, afta di singer rain insult on am sake of comments wey Reno make about im performance for im World Cup concert. Di whole wahala start as Davido perform for di FIFA World Cup countdown concert for Los Angeles. For di show, e wear one jacket wey write di names of over 40 school children and teachers wey kidnappers […]

todayJune 16, 2026 25

Entertainment

Reno Omokri Reply Davido As Dia Two Clash Sake of World Cup concert

By : Jolayemi Olajide Ambassador- to Mexico, Reno Omokri, don fire back at Afrobeats star, Davido, afta di singer rain insult on am sake of comments wey Reno make about im performance for one World Cup concert. The whole wahala start as Davido perform for di FIFA World Cup countdown concert for Los Angeles. For the show, e wear one jacket wey write the names of over 40 schoolchildren and […]

todayJune 16, 2026 21

Sport Yarns

Iran players to Miss World Cup Match cause of Expired Visa to America

By : Jolayemi Olajide Iran national football team don dey complain say one of dia star players, Mehdi Torabi, visa don expire after dia match for Los Angeles. According to di aproko, Torabi only get single-entry visa, unlike im oda teammates wey get multiple-entry, so now e nor fit enter di US again to continue di tournament. Iran Football Federation don already start work to see how dem go quickly […]

todayJune 16, 2026 20

Sports

Mo’ Salah Celebrate Birthday For World Cup

Unto World cup updates, Belgium and Egypt play 1-1 draw for dia World Cup opener on Monday, as Belgian second-half equaliser spoil Mohamed Salah birthday wey turn 34. Emam Ashour naim score first for Egypt early for first half inside Seattle. Romelu Lukaku enter as substitute, naim con force Egypt player Mohamed Hany to score own goal wey level di match. With di result, Egypt still dey find dia first […]

todayJune 16, 2026 25

Sports

Japan Snatch Late Draw As Dem Hold Netherlands

Japan show strong fighting spirit for di FIFA 2026 world cup, coming back twice to force Netherlands play 2-2 draw for dia opening  match for Texas on Sunday. Netherlands captain Virgil van Dijk naim score first with fine header, but Keito Nakamura quickly equalise for Japan. Crysencio Summerville later put di Dutch ahead again with a beautiful goal after one hour of play. As Netherlands begin feel say dem don […]

todayJune 15, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds