By : Jolayemi Olajide
Teachers for Lagos State sef don join di nationwide protest, for dis Oyo school children kidnap.
Dem carry di wahala go Lagos State House of Assembly for Alausa, demanding, say gorment gat raise body for di mata, everyday kidnapping kidnapping say dem don tire.
Di protesting teachers, under di Nigeria Union of Teachers, trek from Ikeja Under Bridge, raise dia voice dey shout abeg oh rescue our children for us.
Lagos NUT Chairmo, Akintoye Hassan, even dey di protest ground and im explain say di protest no be only because of the recent Oyo kidnapping incident but to call attention jaguda boys doings across di obodo Nigeria.