Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Governor Seyi Makinde don blast President Bola Tinubu government say dem no sabi di average cost per kilometre of di Lagos-Calabar coastal road project. Makinde talk dis one on Thursday for Ibadan during di Stakeholders’ Consultative and Engagement Meeting on Oyo State 2026 Budget. Di governor accuse Minister of Works, David Umahi, say him dey dodge di question when dem ask am how much be di average cost per kilometre for di road. “You dey ask minister how much be di cost and he dey dance around say next kilometre no be like next kilometre? Then wetin be di average cost?” Makinde ask.
Makinde come use him own projects as example, say na simple maths. “Moniya to Iseyin na 65km, we do am for 10 billion – about 153 million per kilometre. Oyo to Iseyin na almost 10 billion for 34 or 35km – that one na about 238 million per kilometre. Iseyin to Ogbomosho na 76km, cost 43 billion – about 500 million-plus per kilometre. E no hard.” Di governor say transparency dey important, unlike Umahi wey for one recent interview dodge di same question and talk say cost per kilometre no dey relevant because every kilometre get different cost due to terrain. Umahi still add say work dey go on steady for five states – Lagos, Ogun, Ondo, Akwa Ibom and Cross River, and say na proof of Tinubu determination to boost Nigeria transport system.
Written by: News Editor 2
Lagos-Calabar highway cost controversy Seyi Makinde on Lagos-Calabar road
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025