OBODO NAIJA

Tinubu Leave France, Dey Go Lagos For Political Meetings

todaySeptember 29, 2026 8

Background
share close

 

By: Mariam Ajayi

Presido Bola Tinubu don round off im vacation for France, as e don comot Paris dey head Lagos, where e dey expected to meet political big men and im loyalists ahead of 2027 election.

According to statement wey im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, release on Tuesday, Tinubu plane go land for Murtala Muhammed Airport, Lagos, later today.

Tinubu comot Abuja on August 30, spend one week for London before e move go Paris for di remaining part of im vacation.

Di Presidency say Tinubu choose to first touch ground for Lagos to remember late Chief MKO Abiola, wey win di June 1993 presidential election and fight for democracy for Nigeria.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds