OBODO NAIJA

Tinubu Reforms Don Put Nigeria Economy For Growth Path

todaySeptember 29, 2026 5

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Nigerian billionaire businessman, Femi Otedola, say Presido Bola Tinubu economic reforms don put Naija on road to sustainable growth.

Otedola make di statement on Tuesday after private dinner with Tinubu for Paris, France, as e praise di President reforms and say di results dey become more visible.

E point to Nigeria return to FTSE Russell Frontier Market classification, gains for di Nigerian Exchange, increase for foreign investment and better stability for di foreign exchange market.

Otedola also say Naija foreign reserves don reach about 55 billion dollars, as e mention di stronger FX market and increase for foreign investors confidence.

 

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds