Nigeria's Tobi Amusan reacts during the women's 60m hurdles final at Astana Indoor Meet for Amin Tuyakov Prizes during the 2024 World Athletics Indoor Tour Gold in Astana, on January 27, 2024. (Photo by STRINGER / AFP)
By Ebi Oboko
Beta start for Tobi Amusan as she begin di new year as one of di top-three for World Athletics ranking for 2025 season.
She join two oda Naija athletes – Ezekiel Nathaniel and Chukwuebuka Enekwechi – wey sti dey top 100 for world.
Tobi wey be hurdling queen collect silver medal for 100m hurdles for Tokyo 2025 World Athletics Championships.
She gather 1,430 ranking points, just dey behind Ditaji Kambundji from Switzerland and Grace Stark from America.