Business

“Trump Dey Happy With Dangote Refinery” — Aliko Dangote

todayDecember 15, 2025 4

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

President of Dangote Refinery, Alhaji Aliko Dangote, don calm di internet, talk say US President Donald Trump no get any wahala at allwith di $20 billion Dangote Refinery.

E yarn dis while e dey react to social media gist wey scatter everywhere, wey some people begin talk say Trump no happy say Africa biggest refinery dey Nigeria.

Di talk burst afta Trump threaten say im go hit terrorists wey dey attack Christians for some parts of Nigeria, and people begin wrongly join am with refinery marras.

Dangote clear am say di threat na security issue, no be business or refinery palava, and e beg Nigerians make dem focus truth and no carry fake news waka.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app