Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Oyo State Police command don konfam say two pipo kpai and many others collobi wunjury after one big askident wey hapun for Soka Junction, Oluyole, Oyo State on Saturday night.
Police tuk tuk person, Olayinka Ayanlade, na im dey explain dis mata give tori pipo on Sunday.
According to Ayanlade, di gbege start when one white truck, say na one Abdullahi Bashiru bin dey drive dis truck, lose control because of speed, jam pipo wey dey waka for dia own coner.
Say like dis na, di mata dey police hand, as dem touch light everything way cause di askident.
Written by: Ridwan Agbomeji
car accident Oyo State ROAD ACCIDENT
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026