US Vice Presido, JD Vance land for airbase near Islamabad on Saturday, ahead of negotiation with Iran to end Middle East war.
Iran delegation wey pass 70 people, wey parliament speaker Mohammad Bagher Ghalibaf lead, reach Islamabad first under tight security.
Di Vice presido yarn say US dey ready to open hand if Iran negotiate well, but if dem wan play game, US team no go soft.
As for Iran dem dey insist say make ceasefire start for Lebanon, and make dem unfreeze dia assets before full talks, but both never happen.
US Presido, Donald Trump also demand make dem reopen Strait of Hormuz as condition for two-week ceasefire wey make negotiation possible.
Di strait wey about one-fifth of world crude dey pass never fully reopen, and Trump talk on Friday say e go open am soon with or without Iran.
Trump sti add say im main aim for di Islamabad talks na to make sure Iran no get nuclear weapon at all at all.