By: Rilwan Agbomeji
Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) omo don share update oh, say two people kpai for diesel tanker explosion wey happen for Badagry expressway, Oto-ijanikin axis near Lagos state university of education.
LASTMA tuk tuk persin Adebayo Taofiq, explain say, di accident happen when di tanker driver dey try overtake anoda motor with too much speed and lose control.
According to Taofiq, di tanker crash burst into fire, trap di driver and one adult woman inside, and both of dem die on di spot.
Taofiq add say LASTMA officials quickly secure di area and call Lagos fire service, FRSC, and Ijanikin police division to respond and avoid anoda accident