By: Rilwan Agbomeji
Unto wahala report for Lagos, say two people, wey dem never fit get name na kpai forĀ suspected cult warling warling for Ajah area, Lagos state.
Kofam aproko gather say, di incident happen for Tuesday night.
Dem talk say di attackers enter one crowded area near Ikota complex, come start to dey shoot anyhow.
Di shooting make plenty people for community and market run for safety, cause gbege everywhere.
An as at di time wey wi package dis report, di Lagos state police never sti put mouth explain wetin really play for di area.