obodo oyinbo

US Don Send Over 25,000 Migrants Go Third Countries

todaySeptember 21, 2026 2

Background
share close

By: Kofoworola Olayinka

US gornment don deport at least 25,447 migrants go countries wey dem no get connection with, since Presido Donald Trump enter office for January 2025.

 US don make secret agreements with 35 countries to receive migrants wey America no fit legally send back to dia own countries, with about $410 million set aside to support di deportation programme.

About 20,000 of di migrants don go Mexico, while others don reach countries across Africa, Latin America and di Pacific, including Cameroon wey receive dia first deportation flight on January 14.

Lawyers say some deportees fit enter wetin dem describe as “legal black hole,” because dem dey detained for countries wey dem no get connection with and where dia legal rights fit limited.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds