obodo oyinbo

US Teen Weh Dem Accuse Say E Kill Mama, Brother After ChatGPT Search

todayAugust 17, 2026 4

Background
share close

By: Kofoworola Olayinka

Police for Massachusetts don charge teenager Aravind as adult for allegedly killing him 45-year-old mama, Sudha Venkatesan, and him 14-year-old brother, Siddharth, for dia house for Acton.

Middlesex District Attorney Marian Ryan say police find some disturbing thing for Aravind internet activity, including searching for idea about killing family member on ChatGPT.

Police go di house around 6:30 p.m. on Tuesday after Aravind papa ask dem to check on di family because a tutor could not enter di house and nobody answer call.

Police find Siddharth dead for di first floor and later find him mama dead for di basement, while Aravind plead not guilty and court order say dem hold am without bail.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds