By : Jolayemi Olajide
Dey say goat wey stubborn follow lion enter bush, na im body go tell am say forest no be play ground.
na serious wahala wey dey brew for Mexico City.
Teachers wey dey vex don use rope pull down three giant football player statues, tear jersey commot, even set am on fire.
Dem dey para say gornment no answer dem for dia labour demands as cost of living wan kpai di living.
Di teachers’ union, CNTE, sti warn say if gornment no act fast, bigger protest go burst.
Dem even tuk say dem fit storm World Cup opening on June 11 with mass demonstration.