Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Mavin Records oga, Don Jazzy don open up again about why e still dey single, say e dey fear marriage and di reason don make fans dey talk for online. As e yarn about love and relationship, di award-winning producer say sometimes e dey happy when e see couples wey dey enjoy dia love for social media, but e go come begin worry when e read about divorce and broken marriages. Don Jazzy talk say many men dey lose half of wetin dem work for during divorce, especially those wey no sign prenuptial agreement. “You go see person wey don work all e life, now e go dey share money because of divorce. I dey fear those things, my money na for my generation,” e talk with laugh.
Di 41-year-old music producer still reveal say e don date before but now e dey single and dey wait for di right woman. “I don date before, but for now I dey single. I dey fear, but na God time go sure pass. I just dey wait for di right person, even though I no sure if I sef be di right person for somebody daughter,” e talk. Fans rush react online, some hail am for being real, while others joke say “Na Hakimi move Baba wan play.” But some still encourage am make e no give up on love, say di right woman go show. One thing clear sha, Don Jazzy no ready to risk im hard-earned money for love anytime soon.
Written by: News Editor 1
Don Jazzy fear of marriage Don Jazzy interview
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025