By: Rilwan Agbomeji
Leeds United oga, Daniel Farke yarn say dem jam Chelsea 3-1 Wednesday night because im players really carry fire put show, run dem blues all over for dia house, no gree give dem chance to breathe.
Farke dey shine eye as Ao Tanaka, Jaka Bijol, and Dominic Calvert-Lewin burst goals wey scatter Chelsea defense, carry Leeds run riot for Elland Road.
We dey mad hungry to carry dis club back to top form, Farke yarn.
Leeds don run comot from relegation zone after di big 3-1 win, as Chelsea sharp-sharp drop to 4th for table.