By: Esther Ayoola
FCT Minister, Nyesom Wike, according update, enter Nentawe Yilwatda, APC national chairmo Abuja residence on Tuesday.
Di visit dey come as APC screening committee wey All Progressives Congress set, clear 33 aspirants and disqualify 65 others out of 98 pipo wey apply for 32 House of Assembly seats, based on issues like bribery allegation, fake or incomplete documents, invalid voter cards, and membership wahala.
Di committee report explain say di screening na to ensure proper compliance and party discipline before di elections.
However, details of wetin Wike and Yilwatda tuk inside dia closed-door meeting, never come out, but e dey linked to di ongoing Rivers State political crisis.