By: Rilwan Agbomeji
Area don spoil for lagos oh, say senoir man, Nobel Laureate Wole Soyinka don cut chain follow Seyi Tinubu , dey ask why im go carry plenty armed security dey waka for Lagos.
Soyinka yarn di matter on Tuesday for Lagos as im dey present award give poet Odia Ofeimun, say im count about 15 officers wey carry heavy guns with Seyi.
Im even throw small joke say instead make government send soldiers go stop coup for Benin, dem for just send Seyi with im security team.