“breaking news Nigeria”

7 Results / Page 1 of 1

Background

OBODO NAIJA

Why Court Wan Wipe ADC From Di 2027 Election

African Democratic Congress (ADC) don reject one Federal High Court judgment wey order INEC to deregister dem and four other political parties. U sabi say, Justice Peter Lifu of di Federal High Court for Abuja give di order on Monday, say di parties no meet constitutional and electoral requirements. Di party Publicity Secretary, Bolaji Abdullahi, naim con sorosoke for statement to reply, post for X, say di judgment dey unconstitutional […]

todayJune 16, 2026 5

OBODO NAIJA

President Tinubu Approve ₦10B Emergency Fund

Oga Presido Bola Tinubu don approve make dem set up Presidential Task Force to prepare Nigeria against Ebola virus and other health issues. Di Presido also order, make dem release ₦10 billion emergency fund sharply to help build wall of Jericho against di  disease. Dis na According to im tuk tuk person, Bayo Onanuga, say di money go hellep di NCDC, how dem dey respond to sickness. Dis task force, […]

todayJune 10, 2026 8

OBODO NAIJA

Senate Push For State Police

Senate don drop microsoft word say dem go begin urgent discussion on state police dis week to hellep tackle di rising insecurity for di country. Senate Leader, Opeyemi Bamidele, naim tuk dis one for statement, say di mata don become top priority inside di ongoing constitutional review process. Im say dem don already dey meet stakeholders and dem go quick pass di bill so e fit move go state assemblies […]

todayJune 9, 2026 8

OBODO NAIJA

We Go Rescue Kidnapped Oyo, Borno Pupils – FG

Di Federal Gornment don assure Nigerians say dem dey do everything possible to rescue di 82 pupils and teachers wey kidnappers dem carry for Oyo and Borno States. Di Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, tuk dis one on Thursday for Radio House, Abuja, during one special national security tuk tuk wey dem do for Abuja. According to Idris, Baba Seyi don direct security agencies to move fast […]

todayJune 5, 2026 7

OBODO NAIJA

Court Grant El-Rufai ₦100m Bail

By : Jolayemi Olajide Justice Joyce Abdulmalik for Federal High Court for Abuja on Monday grant former Kaduna State Govo, Nasir El-Rufai, bail of ₦100 million naira. Di judge give di ruling for Abuja say di bail come with strict conditions wey include say di surety must live for Maitama or Asokoro. Justice Abdulmalik also order say di surety must be federal civil servant no below Grade Level 17 and […]

todayMay 18, 2026 10

National

Wole Soyinka Drag Seyi Tinubu Like Tiger Gen

By: Rilwan Agbomeji Area don spoil for lagos oh, say senoir man, Nobel Laureate Wole Soyinka don cut chain follow Seyi Tinubu , dey ask why im go carry plenty armed security dey waka for Lagos. Soyinka yarn di matter on Tuesday for Lagos as im dey present award give poet Odia Ofeimun, say im count about 15 officers wey carry heavy guns with Seyi. Im even throw small joke […]

todayDecember 10, 2025 29

National

FG No Pay Ransom To Free Kidnapped Victims — Senate Talk

Di spokesperson for di Senate, Yemi Adaramodu, don dismiss claims say Federal Government pay ransom to free di schoolchildren wey bandits kidnap for Kebbi and Niger states. E tok dis one for Channels Television Morning Brief on Friday, as public suspicion dey rise about how recent rescue operations take happen. Adaramodu, wey represent Ekiti South, insist say government no give kidnappers any money, even though Bayo Onanuga, Special Adviser to […]

todayNovember 28, 2025 25

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds