By: Rilwan Agbomeji
Fighting don break for Yemen, for Hadramout province wey dey near Saudi Arabia, between forces wey follow Saudi-backed govo and di Southern Transitional Council (STC) separatists.
STC talk say Saudi Arabia dey bomb dia pipo near di border, but oga govo, Salem al-Khanbashi yarn say dem just wan take back military bases “peacefully and systematically.”
STC tuk, tuk, Lieutenant-Colonel Mohamed al-Naqib yarn say dia dey fight serious war against Saudi-led coalition wey dey support govo.
Di fighting burst based on air strikes from Saudi-led forces afta STC begin take some territory for di south.