Delta State Police Command don arrest popular content creator, Ifeanyi Ogbonna, wey people sabi as “Odogwu of Asaba,” over allegation say e rape one 20-year-old woman wey later die for hospital as she dey receive treatment.
Police Public Relations Officer for Delta State, SP Bright Edafe, make dis one public for statement wey e post for X on Wednesday.
Police tok say dem arrest di 40-year-old Asaba resident after allegation say e invite di young woman come Delta State, tell am say e wan mentor am for content creation.
According to police investigation, di suspect allegedly corner corner di woman carry am go one hotel room for Asaba, where e allegedly assault and rape am.
Police say investigation into the case still dey continue.
Full video on Instagram:Â https://www.instagram.com/reel/Da0nozZI4h4/?utm_source=ig_web_copy_link&igsh=MzRlODBiNWFlZA==