Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Bafana Bafana captain Ronwen Williams talk say dem want remain for top position for Group C and no wan depend on wetin happen for other matches. Hugo Broos’ team go host Nigeria Super Eagles for 2026 FIFA World Cup qualifying matchday eight at Toyota Stadium, Bloemfontein today (Tuesday). South Africa still dey top Group C with 16 points after seven matches, while Super Eagles dey third with 10 points from the same number of games.
Williams talk say dem go continue do their own thing and no go worry about wetin other teams dey do for Group C. “The most important thing na to get the job done. We no want make anybody do us favour, we want do am our own way,” Williams talk. “We learn one hard lesson some years ago when our destiny dey for other team hand and thing no follow our side. So, we learn and grow as a team, and now we want do things our way.” The match go start by 6pm local time (5pm Nigeria time) today.
Written by: News Editor 1
2026 WORLD CUP QUALIFIERS Bafana Bafana Super Eagles
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025