Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Economics
todayAugust 22, 2025 15 3
Naija don spend around $100,000 (N150 million) for one medium-range precision weapon wey fit put for drone, na wetin Chief of Defense Staff, General Christopher Musa talk. E talk say drone warfare no cheap at all, so dem gats dey careful where dem go use am to get better result. E give example say just two weeks ago, dem do one successful strike wey kill over hundred insurgents and destroy more than 50 motorcycles because timing set, dem ready, and drone dey. But e still talk say Naija never get real-time satellite technology wey go help for modern war, and that technology too expensive to buy because dem no produce am here.
E also talk say e take security forces six years to track leaders of Ansaru terrorist group because dem dey waka well well. Some local communities still dey support insurgents by using religion to confuse people, especially for border areas, where Lakurawas first settle and later start taxing the locals before turning against them. General Musa still talk say security forces dey try remove Lakurawas for North-West and make e clear say national defense suppose start from education, so e suggest security studies enter primary school curriculum to make sure people sabi their civic duties early. According to am, if government fit improve satellite capacity, education, and make everybody dey alert, e go help fight insurgency better and protect Naija well.
Written by: News Editor 1
Defense National Security
todayMarch 26, 2025 66 3
todayMarch 26, 2025 51 1