Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Niger Tornadoes first match for di 2025/2026 NPFL season no go happen for their home ground again. Di game wey dem suppose play against Nasarawa United don shift go Ilorin Township Stadium. Di match go now hold on Wednesday, 27th of August, 2025. Wetin cause di change? NPFL talk say di stadium for Minna Bako Kantagora Stadium no meet di required standard wey clubs suppose get under the Club Licensing regulation.
Dem send letter give Tornadoes, wey NPFL Chief Operating Officer, Davidson Owumi sign, tell dem say until di stadium ready, dem no fit host any match for there. Di letter come talk say if Tornadoes fit find another stadium wey better pass within 24 hours, dem fit use am. But if not, Ilorin go be their new home for now. So as e be, no more Minna for NPFL matches until that stadium don meet standard. For now, na Ilorin go host Niger Tornadoes’ home games.
Written by: News Editor 1
NFPL 2026 NIGERIAN FOOTBALL Sports STADIUM
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025