Local

ASUU Beg National Assembly Make Dem Step In As Strike Wan Start

todayAugust 26, 2025 9

Background
share close

ASUU don blow final whistle give Federal Government say strike fit land anytime if dem no act fast. Di Academic Staff Union of Universities (ASUU) don raise alarm say di Tinubu-led government dey push university lecturers to the edge, and any small push now fit lead to a full-blown nationwide strike. For press briefing wey happen for Federal University, Oye-Ekiti (FUOYE), ASUU Akure Zonal Coordinator, Prof. Adeola Egbedokun, talk say for over two years now, government never fulfill any of di union demands and the list long and dem include; implementation of di 2009 agreement, proper funding of universities, payment of 25–35% salary arrears, overdue promotions, unremitted deductions, and victimization of lecturers for some institutions. E say lecturers don tire to dey beg, and di union don reach breaking point. “Trust don break, patience don finish, na only serious action from government fit calm this storm,”.

ASUU don also call on National Assembly, traditional rulers, religious leaders, and Nigerian students make dem beg government to act now before e too late. Di union warn say government dey play politics with the future of Nigerian universities. Prof. Egbedokun sharply reject di new student loan policy, say na trap to enslave lecturers and kill their cooperative systems. “This loan wahala na scam, e go drown lecturers inside lifelong debt wey dem no fit recover from,” According to am, ASUU members don already begin peaceful test-run rallies for campuses across di zone, just to prepare ground if government no gree act. With di next official meeting set for August 28, 2025, ASUU don make am clear say di ball dey government hand and if dem fumble, na dem go carry di blame when strike go finally burst.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app