Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
One comedian, Odey Mathias wey dem sabi as General Odey, don talk how e suffer for kidnappers hand for almost 50 days. “E be very bad experience and e be something wey I no fit even imagine, and I no go wish my enemy make e experience am,” na so e talk for Channels TV The Morning Brief programme on Thursday. E talk say dem kidnap am on April 18, 2025, with 23 other people, as dem dey go Calabar through Oron/Uyo waterways. According to am, kidnappers fire gunshots. Then one big boat jam their boat, dem carry dem enter another boat. E talk say for 40 minutes, dem drive dem go one place wey dem no sabi. Mathias talk say e stay for kidnappers hand for almost 50 days, time wey pass others wey dem kidnap with am. E think say na because e wear military general uniform, na why dem hold am long. E talk say dem drill dem, beat dem, starve dem, and dem no gree make dem look kidnappers face and if dem look, dem go hit dem.
E explain say the place wey dem stop resemble creek and na community and some kidnappers get family for there. Dem dey play loud music and shoot gun for air, and dem carry us go places wey network strong to make calls for ransom. I no gree talk to my family like others,” na so e talk. According to Mathias, him family dey work with security agency to find way to locate and free am, na why kidnappers ask for another money after first one dem collect. “I no fit talk to my family; I only talk to my wife twice, one week after dem kidnap me and the day wey dem go release me.” When I come out, I discover say dem kidnappers don collect some money. Dem collect two times; first one pass three million. But after dem pay first one, dem no gree release me and dem tell my family say dem want more money and make dem find extra money. The total money wey dem collect reach eight million naira,” na so e talk.
Written by: News Editor 1
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025