Lagos

Lagos Pension Commission Don Pay N1.52b To 798 Retirees

todaySeptember 10, 2025 5

Background
share close

Governor Babajide Sanwo-Olu government no dey play when e come to take care of senior citizens and retirees wey don serve Lagos State. Dem just pay N1.52 billion to another set of 798 people wey don waka comot from Lagos State Public Service. For the 110th Batch Retirement Bond Certificate Presentation wey happen for Alausa, Ikeja on Monday, dem hand out retirement bond certificates worth N1.52 billion. Plenty retirees show body for the event, come collect their bond papers face-to-face. For the ceremony, the Lagos State Pension Commission (LASPEC) Director-General, Mr. Babalola Obilana, talk say this kain move show how Governor Babajide Sanwo-Olu serious to make sure retirees no dey wait before dem collect their money. He also yan say Lagos dey run pay-as-you-go pension system, so once paper work finish, payment no go delay at all. He yarn say: “Today ceremony na proof say Lagos State Government dey serious about the welfare and financial security of their workers. E show say dem dey fulfill their duty under the Contributory Pension Scheme (CPS), to make sure say our retirees collect the money wey dem hustle for all their years of work.” “The Lagos State Government don do plenty work for pension matter over the years, even though wahala dey. Today, we fit talk say CPS for Lagos State na one of the best and well-managed pension systems for the country. Lagos State Pension Commission (LASPEC) dey always work hand-in-hand with Pension Fund Administrators, Annuity Service Providers, Lagos State Ministries, Departments, Agencies, and other correct bodies to make sure pension matter for retirees dey waka smooth.”
I wan thank Mr Governor, Babajide Olusola Sanwo-Olu, for always dey support to make sure pension money dey pay quick quick. Today, Mr Governor go give another 798 retirees their retirement bond certificates wey worth N1,520,223,053.19, na their past service money before Contributory Pension Scheme (CPS) start for 2007.” Obilana yan say LASPEC no dey carry last for payment matter, dem dey always make sure pension money land on time. E talk say the 110th Batch go join long list of retirees wey don collect their money sharp sharp, as dem dey hold their promise to give public workers better money security. E still advise all the retirees wey dey the event make dem use sense plan how dem go spend their retirement money.

After dem collect their bond certificates, Mrs Funto Olaitan Aina and Mr Olayinka Ramoni Alaka talk say dem really dey grateful to government, say the bond na timely and life changer. Dem also hail Babajide Sanwo-Olu government for steady hold the matter well and beg make dem continue to improve the pension system for all those wey go retire for future. “I happy well well. We don dey wait for our bond, and now e don land for our hand. We dey thank Lagos State Government for making am happen. When I collect the money, I go siddon reason well about how I go take spend am before I run anywhere. The payment quick because I retire last year, and I dey get my bond certificate after one year. So, I dey beg make dem continue to dey do better,” na so Aina yarn, wey retire from Ministry of Environment and Water Resources. Olayinka Ramoni Alaka, wey retire last year from Lagos State Public Service, yan say: “I dey happy die as I dey collect my pension today. I be Town Planner and I still dey do my work. I go add this money to my hustle, continue to dey grind. Lagos State Government dey do their thing well well. From wetin I don see for other states, dem no dey pay pensioners like Lagos. Lagos dey pay quick quick, no yawa for the whole matter.”

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app