Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Barring any last-minute change, di Academic Staff Union of Universities (ASUU) go begin one two-week nationwide warning strike from Monday, October 13, 2025, to press dia demands from di Federal Government. Dis one dey inside one memo titled “Strike Bulletin One” wey dem send give all branches, wey our correspondent see for Abuja. Di planned strike come after one two-week ultimatum wey di union give government last week to handle unresolved matters, like di signing and implementation of di renegotiated 2009 ASUU-FGN Agreement. For di fresh memo, ASUU National President, Prof. Chris Piwuna, lament say government never give any serious response even after di ultimatum. Him talk say for NEC emergency meeting on September 28, dem review referendum results across branches and decide to give government 14 days to act. If dem fail, di union go enter warning strike.
Di resolutions don reach Labour Minister, Education Minister and NLC, but one week later, nothing don happen. Prof. Piwuna thank ASUU members for dia patience for di long negotiation wey don drag over eight years. He urge members to stand united, mobilise well, and follow only dia branch chairmen for updates. He say di goal of di strike na to force government to sign and implement di agreement and stop brain drain (japa syndrome), plus reposition Nigerian universities. Meanwhile, Federal Government don reconstitute one committee to speed up talk with varsity and poly unions. Also, NAAT don give FG 14-day ultimatum over failure to honor key agreements. Dem vex say Ministry of Education never call meetings to resolve matter. Dem raise issues like incomplete 2009 Agreement renegotiation, unpaid allowances, delay in salary, and slow career progression. NAAT say if FG no act fast, dem go declare industrial action too.
Written by: News Editor 2
ASUU Nigerian University Strike
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025