National

Enugu Gov Peter Mbah Don Waka Comot From PDP Go APC

todayOctober 14, 2025 6

Background
share close

Enugu State Governor, Peter Mbah, don officially comot from Peoples Democratic Party (PDP) join All Progressives Congress (APC). He announce am during one state-wide broadcast to Enugu people. Mbah talk say e make sense to waka go APC so dat Enugu fit connect better with central government. E talk say, “There comes always time wey person gats make bold choice to determine im destiny. After plenty reflection, we decide to leave PDP, join APC.” E thank PDP for di support during di years but say dis move na for di sake of im administration goals.

Mbah also yan say e join APC to serve Enugu people well and align with APC vision for development. E believe say APC go give better chance for collaboration and progress. E hail President Bola Tinubu for di support wey Enugu dey enjoy under im leadership. Di governor waka go APC with House of Assembly members, councillors, chairmen, and others. Di move follow Bayelsa Governor Duoye Diri defection, wey dem don finalize. Earlier dis year, Delta Gov Sheriff Oborevwori and Akwa Ibom Gov Umo Eno move join APC with all dia officials and appointees.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app