Like dis Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, wey be di daddy of di Naija number one business centre state, don package christmas gift oh, dat di Opebi-Mende Link Bridge don dey about 80 per cent completion, and dem go open for di holiday doings.
Di govo dey fry dis tok as hin go use hin two gbejero see di bridge over di weekend.
Sanwo-Olu explain say he visit di site to know wetin delay di work and to check di progress, say why dem nor rush di work na to ensure say dem deliver beta work to Lagosians.