Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Minister of FCT, Nyesom Wike, don tackle Labour Party presidential candidate, Peter Obi, over wetin he talk say public schools for Abuja dey in bad condition. Obi bin visit LEA Primary School for Kapwa and describe di poor state of di school as national disgrace and show say Nigeria no serious with education. But Wike, during di commissioning of new roads for Abuja on Thursday, fire back say Obi just dey do eye service ahead of 2027 elections. “You no go become Nigeria president just because you dey do birthday for IDP camp. If you really love Nigeria, why you no dey do all dis when you be governor for Anambra?” Wike talk.
Wike also yan say Obi dey use propaganda and dey politicise everything. E promise say by next week, dem go show wetin his administration don do for FCT public schools. Di minister even mock Obi political ambition, say di former Anambra governor go continue to “contest for social media” but e no go smell presidency. E add say Obi no fit even manage him own party talk less of to manage country. As at di time dem drop dis report, Obi never reply Wike back.
Written by: News Editor 2
Peter Obi birthday at IDP cam Wike blasts Peter Obi
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025