Uncategorized

Must Read: Ebola Show Face Inside Nigeria Again

todayOctober 22, 2026 6

Background
share close

As Nigeria don konfamate one case of Ebola virus disease wey involve Bundibugyo strain, di same strain wey dey cause serious outbreak for Democratic Republic of Congo (DR Congo). Dis particular issue don make health ogas to put body for monitoring and emergency response, so dat di disease nor go spread go every corner inside Nigeria.

On Tuesday, October 20, 2026, di Federal Ministry of Health and Social Welfare announce say laboratory test konfamate di infection inside one woman body, wey enter Nigeria from Uganda. According to reports from di World Health Organisation (WHO), di woman start to dey show sign for October 7, four days after she enter inside Naija. On October 11, she kon go hospital go check how bodi dey do her, na so lab test konfamte di Bundibugyo virus on October 20, nine days after.

As we dey tok like dis, di Nigeria Centre for Disease Control and Prevention (NCDC) don point 44 pipu wey get close contact with di patient, and Health ogas dey monitor dem to check whether anybody don catch di virus. Dem also dey investigate di woman movement, put better weight on top ways wey dem go use take make sure say di disease no spread reach health workers and other patients.

 

Wetin Be Bundibugyo Ebola Virus?

Ebola na serious disease wey fit cause fever, weakness, headache, body pain, vomiting and diarrhoea. For severe cases, e fit cause bleeding and damage to important organs inside di body.

Di way di virus dey spread be say, once pesin touch blood or other body fluids of another pesin wey get di virus, him/her go get am. and pesin fit also catch am through contaminated objects and materials.

Di Bundibugyo strain dey cause serious issue because no approved vaccine or specific antiviral treatment don dey for dis disease. However, doctors fit provide supportive treatment wey go hellep patients manage di disease.

 

Federal Gornment Action on Top Di Matter

As soon as federal gornment konfamte di case like dis, dem sharpaly activate public health response wey involve di Nigeria Centre for Disease Control and Prevention (NCDC), FCT health authorities and other relevant agencies.

Di response include tracing pipu wey get contact with di patient, monitoring possible infections, isolating di confirmed patient, strengthening hospital safety measures and reporting suspected cases sharpaly.

World Health Organization (WHO) dey support Nigerian authorities with technical advice, protective equipment and other important supplies.

Di organization don also advise countries say make dem put more power to monitor di disease, do more laboratory testing and emergency response, and also monitor airports and points wey di disease fit pass enter.

Health ogas also chook, tell hospitals and other health facilities say make dem shine dia eye,  identify suspected cases sharp sharp , isolate patients where necessary and report dem to appropriate public health agencies.

 

No Fear, Nigeria Don Contain Ebola Before

No be di first time wey be say Ebola Virus go enter Nigeria, come cause serious tension for pipu mind be dis.

For inside 2014, di virus enter Lagos through one pesin wey just travel come back from Liberia and he no know say hin don catch am.

But agencies sharpaly identify di case, trace pipu wey fit get am, isolate pipu wey don already get am and join bodi with public health response, to make sure say di disease go spread reach everywhere and Nigeria show am shege dat time.

But dis current case na Bundibugyo strain, and e dey different from di di Zaire strain wey bust for 2014.

For now, di main thing na to identify everybody wey fit don come in contact with di infected woman, protect health workers and stop di virus from spreading to more people.

However, konfamate on top informate of one case no automatically mean say widespread transmission don begin for Nigeria.

Di outcome of contact tracing and further surveillance go hellep authorities determine whether di virus don spread beyond di confirmed patient or not.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds