Despite apologies from Nigerian comedian Freedom Atsepoyi, wey dem sabi as Mr Jollof, and social media activist Martins Otse, wey dem sabi as VeryDarkMan (VDM), United Nigeria Airlines don talk say di investigation into di matter still dey ongoing. For separate apology videos, both men share dia side of di story and beg forgiveness from di airline and Nigeria Civil Aviation Authority, acknowledging di wahala wey dem cause. According to previous reports, di duo fit face criminal charges after di clash inside di aircraft wey also cause delay for passengers. For Instagram on Tuesday, Mr Jollof explain wetin lead to di fight, say e no dey violent but na self-defence e act. Im apologise to di passengers, di airline, and di NCAA, promise say e no go ever happen again, and even apologise to im wife and children.
VDM also apologise but admit say e no fit promise say e no go ever fight again, only guarantee say e no go happen for plane or any public place. E admit say e act irresponsibly and say di fight delay travel for many people, including some wey get medical appointments or business matters. But United Nigeria Airlines spokesperson, Chibuike Uloka talk say despite di apologies, di investigation still dey and di airline never take official position on di incident. Uloka emphasise say, “Investigations are still ongoing.”