National

Fresh Kwara Attack – Bandits Kidnap Four Rice Farmers For Bokungi Village

todayNovember 20, 2025 5

Background
share close

Barely 24 hours after di bandits attack wey happun for Eruku town, another group of bandits don launch fresh attack for Kwara State, abduct four rice farmers for Bokungi village inside Edu Local Government Area. Di latest attack happun on Wednesday evening between 6:30pm and 7pm as di rice farmers dey work for dia farms. For di first assault, two farmers dey pack dia harvested rice when bandits carry dem, and moments later, another two people for neighboring farm follow get kidnapped, making am four victims. Sources close to di village talk say di coordinated nature of di attack don heighten fear among residents as di suspected bandits invade di farms, begin shoot sporadically before dem drag di farmers enter bush. Up till now, di bandits never ask for ransom. On Thursday, Residents of Bokungi describe di repeated attacks as alarming and beg security agencies to tighten operations across di Lafiagi–Bokungi axis.

According to some residents, “We no fit sleep with our two eyes again talkless of going to farm,” as fear don grip di whole community because of di incessant bandits attack. Dem call on Federal and State Governments to rise up and bring lasting peace to di area. One senior police officer for Edu Divisional Police Headquarters for Lafiagi confirm di incident, saying dem dey work round di clock to rescue di abducted rice farmers and di state command don dey brief for reinforcement. She come urge residents to dey give relevant information wey go help di police fish out di perpetrators for di area.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app