Wi Oga presido wife Senator Oluremi Tinubu, don call Nigerians make dem renew their commitment to end HIV/AIDS by 2030.
She talk this one for statement wey she post for her X handle to mark World AIDS Day 2025 with the theme “Overcoming Disruptions; Transforming the AIDS Response.”
According to her, the day remind everybody say make we ginger our efforts to finish HIV/AIDS once and for all.
She still mention say Nigeria don already make better progress for prevention, treatment and care over the years.