By: Esther Ayoola
Oga presido wife, Lolo Oluremi Tinubu, don share 10,000 sanitary pads give girl students for Jigawa State.
Di gesture come at di time wey stakeholders and UNICEF dey shout make girls take care of themselves during menstruation.
According to aproko, this move dey twin with Jigawa State Government ongoing support for women health, as dem dey join hand fight poverty for di region.
As she dey talk for di distribution event wey happen for Government House, Dutse, Jigawa State capital, Mrs Tinubu say di donation na to improve di health and well-being of girl students for di state.