By: Esther Ayoola
Some jaguda boys again don gbab six real estate marketers for Lagos, while dem dey go inspect their company land for Oyebola village, Obafemi-Owode Local Government Area, Ogun State.
Tori people carry say the victims waka go the land for inspection before the attackers strike.
Police Commissioner, Lanre Ogunlow sef, don confirmate the development give news wakawaka that the incident happen on Friday.
 And that like this like this, police don dey torch light nearby bushes and area to find out wetin really happen.