By: Esther Ayoola
Nor be small mata oh for third mainland bridge, lagos, say fire scatter bodey near rapid response squad (rrs) base for Adekunle, wey dey go Iyana oworo
According to the Lagos State Traffic Management Authority as dem take sukili for social media X. say the fire le gidigan and that e cause better go slow for the area.
Eyewitnesses talk say the smoke choke the area as the fire begin to dey dance daddy shoki near the RRS facility.
On top matas wey reach Konfam aproko dem, nobody still sabi wetin cause the fire, but authorities don mobilise to bring the situation under control.