National

Suspects Don Yarn Reason Why They Kpai Ogun FRSC Officer And Her Pikin

todayDecember 4, 2025 5

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Osun State police command don kramp one jaguda boi, victor fajemirokun wey kpai im girl friend, wey be Federal Road Safety Corps officer, Lasisi Funmilayo and her pikin, Sewa Lasisi.

According to reports, di police parade di forty years old business man alongside two babalawo wey dia name be, Gboyega Daramola and Sunday James, for Osun State Police HQ, Osogbo on Wednesday.

Oga Victor open im mouth confess say im carry both Funmilayo and Sewa from Ogun go Ijebu-Ijesa after one babalawo yarn am say im need baff before everything go settle for im life sake of say Funmilayo don use im glory.

Funmilayo and her pikin wey dem first report miss for Ogun on Sunday, November 2, dem don jam dead for one herbalist corner for Osun, bodi parts dey scatter everywhere, and police yarn say na serious ritual killing.

Victor Fajemirokun don yarn how e carry late FRSC officer Lasisi Funmilayo and her small pikin, Sewa, waka enter deadly trap for Ijebu-Ijesa after e jam one herbalist, Gboyega Daramola, for TikTok.

E talk say im and Funmilayo first plan say dem gats meet di man for spiritual cleansing, but afta Gboyega run spiritual check for am, e yarn say na Funmilayo dey cause all di bad luck for im life, and na why e tell am say make she come with am.

Di man yarn Funmilayo say she gats do cleansing too, then e tell three men make dem carry her go bush to perform am. Na for dat bush dem finish am, Her small pikin wey waka follow dem enter di bush too, carry wahala full ground.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app