By: Rilwan Agbomeji
Labour Party 2023 Presidential Candidate, Peter Obi don drop mata for ground say di way all dis big politicians take dey spend money on top big big motor, na concern.
Obi talk say for time wey Naija pipo neva chop, no gey job , dey fear kidnaping, ni senior political big names  dey spend public money buy big big motor for political campaign, say e no good at all at all.
Obi talk say real oga wey get beta mind suppose dey clear hunger for street, help sick people mata, hook youth with beta beta work, make everywhere dey safe, no be to dey show off big motor dey beg pipo for vote.