Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Rilwan Agbomeji
Imo police don scatter 2 kidnappers, lock 12 for ceil, recover one dead body, dangerous weapons and 12 phones for Obudi/Mgbala Road and Umuezeruokam Forest.
DSP Okoye yarn say DPO squad run down geng wey dey use white mini bus, while CP Danjuma promise say dem no go gree for kidnappers again.
Meanwhile, police don para, reject all talk say dem dey do human rights wahala for Anti-Kidnapping Unit (AKU), wey dem dey call Tiger Base.”
CP don set Human Rights Desk for AKU, warn anybody wey dey spread fake gist say Cybercrime law go catch am.
Written by: News Editor 1
imo state news kidnappers arrested imo kidnapping in imo police operation imo
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025