By: Esther Ayoola
Some armed Jaguda boys, based on rugged movement, don carry their bad character enter St. Andrews Anglican Church for Isiokwe, Lilu, Ihiala, Anambra State early Sunday, burn priest house and kill two people.
According to Eye wey see, one of di persons wey kpai, na di wife of di priest, as them scatter vehicles and properties scatter for the church compound.
Di whole wahala happen early Sunday, stop church activities comot, and people still dey fear for area.