By: Esther Ayoola
Federal Government say dem don take big step to shake life back into Nigeria gas sector and make power supply stable after President Bola Tinubu gree say dem go pay ₦185 billion wey government don owe gas producers .
Minister of State Petroleum Resources (Gas), Ekperikpe Ekpo, yarn dis one on Tuesday say, the move wey National Economic Council (NEC) under VP Kashim Shettima back, na one of di biggest interventions for Nigeria energy sector for recent years.
Di long-standing debt don scatter cash flow, hold back operations, scare investors, and reduce gas wey dey feed power plants, wey dey make light wahala full ground.
Payment go run through royalty-offset system, wey dem believ go ginger confidence among local and foreign gas suppliers.