By: Alice Iduh
Wi oga Presido Bola Tinubu don write Senate say, make dem allow am send Naija soldiers go Republic of Benin as di country ask for help after coup wahala wey bust on sunday.
Oga Senate Presido, Godswill Akpabio, read di letter for plenary, and Tinubu talk say na section 5(5) of di 1999 Constitution give am power to seek dis kind approval.
Tinubu yarn say Benin beg for backup as dem be sister country, and Naija no fit turn face since friendship and brotherhood strong.
Dis move follow di drama wey Lt Col Pascal Tigri and him “Military Committee for Refoundation” take seize Benin state TV on Sunday before fighter jets and troops wey Tinubu deploy scatter di coup attempt.