By: Rilwan Agbomeji
Lagos State government tire shirt oh say say dem go begin remove any building or structure wey people build under high-tension wire because e dey dangerous for residents.
Na for inspection waka wey dem go do for Third Mainland Bridge area, Special Adviser Olajide Babatunde yarn dis one as im see plenty shanty and illegal structures wey no suppose dey di 50-metre right-of-way, im belle even turn am more.
E follow oda government officials waka reach Oworonshoki, Adekunle and Makoko, and dem promise say dem go enforce di law and clear di area.