By: Rilwan Agbomeji
For abuja, afta all di plenty drama for Osun state between di dancing senator and first lady, Oluremi Tinubu, madam first lady don wire birthday message give Adeleke wife, Titilola Adeleke, as she clock 60.
Na for statement wey dem wrap like moimoi drop for her x page, Mama Remi dey hail Madam Adeleke for di serious work wey she dey do to uplift Osun people through di renewed hope initiative.
She talk say di Osun first lady dedication don turn many lives around and her impact dey show everywhere for di state.
To crown di ogbonge greeetings, Oluremi throway better salute wey get odour give Governor Ademola Adeleke, di celebrant childrensis and entire family.